He who fights & runs away ....Na fear catch am.

Pikin wey no sabi em mama boyfriend....Dey call am brother.

A rolling stone no just dey roll....Na person push am.

He who lives in a glass house....Na im pepe rest.

A stitch intime....dey prevent further tear tear.

Birds of d same feather....na d same mama born dem.

One good turn.........na correct power steering be that.

A bird in hand....wetin e wan be again if no be barbeque.

Half bread....is better than buns or puff puff.

D journey of a thousand miles....O' boy e beta make u carry your car go enter aeroplane.

The patient dog....Na hunger go kill am.

All work & no play....Na Banker be dat.

He who laughs last...na mumu, y im no catch d joke d 1st time & laugh when others dey laff!!