Welcome to Nigerian Elites Forum


Dreaming of a better Nigeria.


  •  »We love Nigeria.
  •  »  We want to see a better Nigeria.
  •  »We dream of freedom.

...Join us now!


that is why we are here,we wish to make Nigeria a better place for us and family to live.


Let's create influence towards a better Nigeria now!

Registration is free.

P.s.: For registered members Nigerian Elites Forum is hitch free.

Results 1 to 3 of 3

No Wafu Cup, No More Team B!

No Wafu Cup, No More Team B!  ; I know how many times wey my Popular Side fans don call me and beg me make I help dem tell our NFF oga dem say dem need home-base players ...

  1. #1
    007's Avatar
    007 is offline Nidan model MFR - Member of the Forum NEF
    Member No
    93
    Join Date
    Oct 2009
    Location
    Yola.
    Posts
    74
    Points
    ₦5,750.07
    Thanks
    0
    Thanked 1 Time in 1 Post

    Default No Wafu Cup, No More Team B!



    I know how many times wey my Popular Side fans don call me and beg me make I help dem tell our NFF oga dem say dem need home-base players make dem join dem Super Eagles brodas wey de-play ball for oyibo land.

    As dem talk dat time, dem say wetin make our Super Eagles team no-de do well again na becos of plenty big man and iyanga wey don enter some player head maybe becos of say dem don get money and believe say dem also get automatic shirt for de senior national team.


    Now, NFF people don answer us as dem come gather plenty home-base players and come name dem Super Eagles Team B. Dem say na coach Shuaibu Amodu go be dem Chief Coach while our new oyibo Coach Lars Lagerback go de-watch de boys and pick de ones wey dey good carry go for Team A (Super Eagles). But becos of say Coach Amodu still de vex for de demotion wey dem demote am and no gree accept de job, na'im make dem carry Daniel Amokachi to go handle de team.

    My people, de first assignment wey dis team do, na fumble dem fumble for hand of Niger Republic. Dem go for Niamey and lose 0-2 and come give us assurance say for second leg, dem go show Niger boys pepper for here. But my people, for second leg also, Naija carry Niger team go for Sani Abacha Stadium for Kano and no fit beat dem again. Na so we take comot for Sudan 2011 CHAN race.

    Again dis same team don de play for dis year WAFU Nations cup and na for Abeokuta, Ogun State e de shele. De team still get almost all de boys wey mess up for Niamey and Kano. Dem Coach still be Amokachi. Dem first group match for dis WAFU cup, na 4-0 dem take welcome Benin Republic for Abeokuta.

    De team also salute Guinea with 5-0 for de same stadium before dem jam Senegal last Tuesday. De final go happen dis Sunday for Abeokuta.

    Wetin Popular side wan talk be say our NFF and CAF people don try dem best to make sure say home-base African players get chance to show people dem own talent. Dem don give dem opportunity to play demsef into dem senior national team as oyibo people fit talk am. I even think say with dis our new Coach (I mean Coach Lagerback), our boys for fly as dem neva fly before.

    Now, make I tell dem, if dis home-base boys no carry dis cup dis year, make Naija forget about dem, make we still de-invite all our players wey de play for abroad untillee dem eye clear. Una bye-bye.

    Source :Na for Daily yanpion i see this article by one Henry chandy.





  2. #2
    kontis's Avatar
    kontis is offline Genin MFR - Member of the Forum NEF
    Member No
    585
    Join Date
    Jan 2010
    Location
    Garki.
    Posts
    115
    Points
    ₦6,762.80
    Thanks
    3
    Thanked 4 Times in 1 Post

    Default


    I agree with you my brother,If they no carry the cup,make dey pursue them.



  3. #3
    ben's Avatar
    ben is offline Genin OON-Officer of the Order of NEF
    Member No
    22
    Join Date
    Sep 2009
    Location
    Kaduna
    Posts
    190
    Points
    ₦16,064.89
    Thanks
    1
    Thanked 0 Times in 0 Posts

    Default


    That is not fair,the culture of carry or you are sacked,where is the spirit of sportsmanship ? anyway ,they have won.


    [B][COLOR="Navy"]"Cowards die many times before their deaths but The valiant never taste of death but once.Of all the wonders that I yet have heard,It seems to me most strange that men should fear;Seeing that death, a necessary end,Will come when it will come."[/COLOR][/B]

Similar Threads

  1. Stanbic IBTC Bank Recruits - Team Lead Customer Services
    By davis in forum Jobs and Vacancies
    Replies: 0
    Last Post: 16th February 2010, 05:47 AM
  2. MRI for the under 17 team
    By ben in forum Sports
    Replies: 0
    Last Post: 22nd September 2009, 02:17 PM

Tags for this Thread

Posting Permissions

  • You may not post new threads
  • You may not post replies
  • You may not post attachments
  • You may not edit your posts
  •  
1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 16 17 18 19 20 21 22 23 24 25 26 27 28 29 30 31 32 33 34 35 36 37 38 39 40 41 42 43 44 45 46 47 48 49 50 51 52 53 54 55 56 57 58 59 60 61 62 63 64 65 66 67 68 69 70 71 72 73 74 75 76 77 78 79 80 81 82 83 84 85 86